ONOCHE THE LOCAL CHAMPION.

      ... written by E PLUS The Storyteller.

                     Sponsored by

   IGBESPECIALS DRIED ONIONS.. Your      Prefered Choice.


My name na Onoche, and I no dey fear anybody, no matter who you be! For this village wey all of us dey, Na 'Papi' dem dey call me, simply because I get skill for everything. Well, in two weeks time, dem go add title for my name, Ad'Ogbadibo of Orokam, yes! Whether anybody like am, or dem no like am.

 You see dis my village people, e be like say dem don dey see me finish, but I go show dem say, my name no be Papi for nothing.

   To get the title of Ad'Ogbadibo of Orokam, na serious matter o! Dem say we go fight some people from the other village, den, the winner go carry the title. As for me, I don ready well well! I don dey chop all the food wey go give me power! As a real warrior, no shaking✊ I just dey wait.

Apart from the title, the winner go chose wife among all the girls from the village. Me, Onoche, I get eye for Ojone. That girl fine, no be small! When I win the title, I go marry her.

________________________________________

Chai! e be like say my dream don scatter, because as I dey plan all dis my plan, I no know say, dem go cheat me!

 You fit believe say, after everybody don fight finish, dem defeat dem, when e com reach my turn... I stand gidigba! We fight, fight so tay....as I won com throwaway the other man for ground, dem disqualify me! Na im I start to provoke, the tin vex me, so I ask dem why dem disqualify me nau? Our village priest say, I no suppose join for the fight because I dey owe many people money for the village! And my head no fit carry the title!

Una don hear dat kind tin before? See, how my enemies take plan for me! As I dey so, I dey match go meet some of my guys make we see how we go take protest for dis matter! My title no go lost like dat ooo! I must take that title! Me, Papi, Onoche! Anybody wey block my way, go see any how!

______________________________________


Onions have been quite expensive of late. 

Why don't you try this dried onions.  

It's neat, not sun-dried, and it can last for 6months without going bad. 

You can soak it for an hour, or two and it becomes your regular sliced onions. For more details, send a DM.

 Call/WhatsApp message:

08032626937 


  Instagram

www.instagram.com/igbespecials 


See link for illustration 👇

https://www.instagram.com/tv/CHiUjPYJlpI/?igshid=1vjdhr0aupcvx


Comments

Popular posts from this blog

GREEN LAND. Written by E PLUS The Storyteller.

The Wailing Creatures Written by Sumayyah Oluwafunbi Ogunsola

That’s NOT my father! Sumayyah Oluwafunbi Ogunsola