Posts

Showing posts from January, 2024

TALES OF MADAM APROCO ( The Aproco Series) Created by E PLUS The Storyteller ✍🏿

Image
 TALES OF MADAM APROCO (The Aproco Series) Created by E PLUS The Storyteller ✍🏿      My piple! I dun miss una, no be small tin o! Di tin wey dey hapun to me, ehn...hmmm...my mouth no fit talk am finish, but I go try still gist una, sha  Yesterday, I say make I go market o, go buy banga and local fish wey I go use ginger my level, na im I see my old class mate dey quarrel with one truck driver. I say "Shwuuu! Wetin come dey happun?" Una know me na...as Madam Aproco, I naw fit see sumtin dey happun, make I comot my eye, so I say make I try settle the matter. As I dey waka go front, na im one okada from no where loose break com jam me o! Na so I just fall for ground, yakata with all my fish and banga! Chai! I no even know where to start from...na so evybodi, plus the truck driver and my old school class mate leave their quarrel come dey tell me "sorry o!" Infact, na for inside the truck dem carry me go hospital. My pipple, na so di gbege hapun o! Anyway I dun dey get