MADAM APROCO (Na help I just wun help o!) Created by E PLUS The Storyteller.

 MADAM APROCO

(Na help I just wun help o!)

Created by E PLUS The Storyteller.


My pipu, how una dey? I know say e don tay wey una hear from me, abeg make una no vex for me o! Plenty plenty tins don happun since the last time we talk, and na one of dem I wun share, hmm! See me see wahala o! E get dis my neighbour wife, the woman no dey try, her wahala too much for her husband head, so tayyyyy. . e get one time like dat wey the man wun commit suicide if no be say police enter the matter. Why the man no go wun commit suicide? When e be say the woman no dey siddon for one place! Na so so waka waka, from one man house to anoda, the tin just tire person...So one day I say make I spoil myself small as dem pay us money for one small runs wey I do (my sister connect me and some women to o cook for one big man wey organise party for him Mama)

So, as I enter the eatery, I see dis my neighbour wife dey hold one man as the man hold am for waist! Chai! Na im I clear my eye first, I no fit believe wetin I dey see, the tin vex me well well! No be small tin. I still stand dey look dis my neighbour wife, Nike and dis man dey du love one tin tin without shame. As a good neighbour wey wun help her neighbour, I decide to du sometin, na so I go meet dem, Na im I shout: 

 "Nike! Wetin you dey du with dis man, no be anoda man wife you be?"

Nike com look me like say she no know me, the man ask her:

Who is this woman? And why is she embarassing us?

Nike com answer am:

Sweetheart, I don't know her o! 

The tin come vex me! Nike just pretend like say I fall from sky, but I make up my mind say I go scatter their plan. As I still dey talk to her, Na Im Nike com change am for me, she begin to shout:

This is the same mad woman on my street...I remember, that's how she goes about harassing people! Please help! Help!

Hmmm...my pipu, before I go even open mouth answer her, everybody don dey talk say make dem carry me comot for the eatery, no be small tin o!

  Na so security pipu come carry me comot o! A whole me, Madam Aproco! Com see disgrace! Nike deny say she know me, call me mad woman!

 Anyway I no blame her...Na me wey wun help. Hmmm..abeg make I check food wey I put for fire, I go com back with another gist. Una doh o!!!!

___________________________________________

         WELCOME TO E SHOPPING MALL

                    Shopping online with ease 💃


Nclosure Systems Nig Ltd is a one stop construction conglomerate with awesome products and services .


 We intend to achieve this by providing convenience and lifelong commitment to our customer’s need.

 In order to effectively satisfy our customers we have strategically modeled our company into three subsidiaries, namely:


- Nclosure Builders: which is our consultancy and construction subsidiary.


- Nclosure: Building Materials Contracting subsidiary.


- Nclosure Fix-it: Maintenance & Facility Management services subsidiary.


We are well equipped with skilled technical and administrative personnel, conversant with technological trends and strict quality standards. We are built on a solid infrastructure by reason of our background in satisfying our client’s need for:


- High Quality Products and Services.


- Prompt Delivery.


- Affordable Pricing.


- After Sales Services.


You can reach us via our email👇🏻

nclosures@yahoo.com

08023938985p



                     HIBISCUS ROYALE

                            FACEBOOK

                           hibiscusroyalé


                             INSTAGRAM

            www.instagram.com/hibiscusroyale


                                   SISTO HAIR

                www.Instagram.com/sisto.hair


         HEMKAY DELI-EGGS    
                                  

  HemKay Deli-eggs offers you fresh, and highly nutritious eggs directly from the farm. Pick yours at an affordable price. Delivery is also guaranteed. A trial will convince you.


                           JIGHIFARMS


          https://instagram.com/jighifarms? igshid=16jpme06qmowv


                              ZIPHALEE


           https://instagram.com/ziphalee?igshid=z2ap4afl1yj1



                             LONGGRAIN

                    MEALGRAIN RICE PUDDY..

               ...with Dates the Dried Fruits.

         https://instagram.com/michealinlonge









Comments

Popular posts from this blog

GREEN LAND. Written by E PLUS The Storyteller.

The Wailing Creatures Written by Sumayyah Oluwafunbi Ogunsola

That’s NOT my father! Sumayyah Oluwafunbi Ogunsola