MADAM APROCO'S CORNER.


             MADAM APROCO'S CORNER.

     (Created by E PLUS The Storyteller)

Una doh!!!.my people, how una dey? Thank God for anoda day! On top everytin wey don happun, we still thank God say him keep us alive. E get wetin I don observe since way dis #ENDSARS start.Hmmmm.. no be small tin o...You know say, as people dey shook mouth put for dis #ENDSARS palava, Papa Asabe just siddon dey look? Hmmm..

For my mind I come dey wonder wetin happun? How man go just siddon dey look when other people dey fight, Na man be dat? Anyway, as I dey wonder, dey ponder, Na so I just hear Mama Asabe con dey shout: 

You go kill me today o! You go kill me! 

Shwoooo! Oghene! The tin con fear me oo! And dat day, I bin dey cook Banga Soup and Starch (because my sister, come from Warri con see me) so, na so the gbege start ooo! Mama Asabe still dey shout:

 You go kill me today o! You go kill me today o!

As a good neighbour, I tell my sister make she kontinu with the Banga Soup, make I go check wetin dey happun, na so I waka go deir house ooo! Wetin I see ehnn!!! My mouth open wide so tay one fly almost enter! Na baba God save me dat day.. If you see how Papa Asabe hold him wife neck! No be small tin ooo! Na so I rush go comot him hand before him go kill the woman. Dat day ehn! no be small tin. Na later, I con find out say, na because Mama Asabe no gree give Papa Asabe food to chop, simply becos she say she don tire to cook dat day, finish o! Na him dis man com dey give her blow for face and neck, if no be say me, Madam Aproco, I sharp well well, him for just kill the woman finish, hmmmmm.. 

Na wa o! So I com observe say, no wonder dis man no join #ENDSARS Campaign, yes! Becos himself na original SARS him be! If not, how you won take describe dis kind man wey no get shikini conscience, he just dey deck the woman blow like say him dey practice boxing 🥊 See ehn! Make I warn all of una wey be SARS for house, we dey watch una oo! We dey watch una! Afterall Oyibo say charity begins at home! Watch yourself ooo! ENDSARS! ENDSARS! E start with you o! 

My name na madam Aproco, I no leave una o! Una fit reach me for 07081536821 if una get any jist or won advertise for my corner. I go dey wait. Until then, make una kaja well well.

_____________________________________________


Are you open-minded to generate capitals without using the bank, or dropping collaterals? 

Are you open-minded to learn how to start a risk-free Global business, without loosing money?

LABUENA VIDA PROJECT has a team of experts and diverse network of entrepreneurs involved in different industries that will teach you how.

Click the link for more

https://surveyheart.com/form/5f64dd16c366005648fcc8b2

      


************************************************

For your online Creative Writing skills, Visual Arts communication, Blogging and Storytelling Program, call, text or send a WhatsApp message to 07081536821, 08088534380.
You also get a free Audio story by E PLUS The Storyteller after registration.
____________________________________________

And it's finally here..
 TALES OF VERSES by Ejiro Emenike Ukaumune(a.k.a E PLUS the Storyteller) is a collection of stories based on real life experiences which ranges from Rape, Domestic violence, child molestation, human trafficking, Vanity and Family challenges.
 Allthe silent voices who have been unable to speak out against these vices are well represented in these stories. Fictional names have been used to protect the image of the people in these stories.

Click the link to get your copy.


Or send me a direct message with your email, on 08028489362, 07081536821

 You get a free Audio-Visual Story from E PLUS the Storyteller when you get any of her stories, then you get two additional, when you get all the stories
________________________________________

HEY BUBU!


HAIL THE KING...
By Saint Rhemi





Comments

Popular posts from this blog

GREEN LAND. Written by E PLUS The Storyteller.

The Wailing Creatures Written by Sumayyah Oluwafunbi Ogunsola

That’s NOT my father! Sumayyah Oluwafunbi Ogunsola