MADAM APROCO

                     GBEDU WAHALA

   Created/Written by E PLUS The Storyteller



     

The tin wey happun to me last Saturday ehn...hmmm! No be small tin ooo, my people, how una dey? Na me again oh...madam Aproco. Una know say, me I no dey fit keep anytin from una. So, my tori be say, last week saturday, all of us for my compound dey prepare for one owambe like dat...

I knack my big scaf, on top the new white lace wey I buy on credit (I neva even pay finish). As I ready for the gbedu, I chatter taxi, because I no want make the white lace stain, I no fit shout! Na so I balance, I no even bother to wine up the windscreen because the taxi no get AC. Small time, sleep carry me go as breeze dey blow me, the breeze, ehn... no be here o!

Small time, I here 'Gbum!' like bomb!

Na so I wake up o! Before I go open my mouth to shout, na so the driver carry us land for gutter! Hmmm..no be small tin ooo, if no be say, people quick come push the motor to the other side, no be dis one, person for dey yarn by now! 

  Na so everybody just dey tell me,

    "Madam sorry! Madam sorry!" As I land for ground. I no fit even talk, na so gutter soak my fine white lace! As I still dey dey look myself, na im the driver come meet me, talk say, 

  "Madam, abeg  wey your money?"

I no even  know when my back hand woze am slap! As we dey talk  so the driver still dey hospital, police say make I come write statement for Police station, while the woman wey sell the,,, lace to me, dey call me 'Onigbese!'

Anyway I no blame her, at all. No be her fault! My people, una doh! Make I go hustle small, I go come back with another gist, next time. Wekobiwo ooo!

My name still be MADAM APROCO, any other one na counterfeit.

______________________________________





_C.E.O JIRADE DIADEM... VARIETIES OF JIRADE CRUNCHES.

Potato chips, Plantain Chips, Cashew Nuts, and Kulikuli

  www.instagram.com/jiradeventures


    https://www.instagram.com/p/CIEHKAOJoFV/?igshid=jbp3orvo0c4v

______________________________________



Comments

Popular posts from this blog

GREEN LAND. Written by E PLUS The Storyteller.

The Wailing Creatures Written by Sumayyah Oluwafunbi Ogunsola

That’s NOT my father! Sumayyah Oluwafunbi Ogunsola