THE PRESIDENT MUST APOLOGIZE... Written by E PLUS The Storyteller ✍🏿
THE PRESIDENT MUST APOLOGIZE (PART 1) Written by E PLUS The Storyteller ✍🏿 "Try am make I see! Dem no born you well if you touch me!" Laraba screamed. "Are you okay? You dey mad ni? See dis one wey I wun help her destiny! Na im dey do gragra any how! I no blame you! Ah! Maka Don dun suffer! Na Pakolo I blame o! Just dis one night stand wey we parole na im dey make you wun scatter the whole area?" Maka Don lamented. "You neva see scatter! (Laughs hysterically) when I dun finish with all of una, una go trip! Me! Laraba! Hmmm...abeg pay me my money make I comot for here jare!" Laraba reacted. Almost immediately there was a knock on the door. "Na who be dat nau!" Maka Don snapped. "Boss! Na me o! Pakolo! Sumtin just drop nau nau o! You gat to come check am!" Pakolo replied. "Okay! I dey come, make I settle dis level wey dey my front..go wait for your room!" Maka Don said. "Okay Boss!" Pakolo said. "Take your m...